BY LISA BASSEY
Baba Jagaban…
We dey hail you wella,
We need your attention, no be infatuation.
Increase minimum wage, make we fit survive,
No be just survive, but make we all dey thrive.
Baba Jagaban…
Palliatives for transportation,
Make we no suffer for this difficult situation.
Education subsidy, make you no remove am,
Give the youths hope, make we no gree japa.
Baba Jagaban…
No increase electricity tariff,
Make light shine,
We dey beg, No candle for leg.
As we dey hustle and sweat,
Make we no drown for darkness,
Cost am from una hardship allowance
Baba Jagaban…
Listen to we the common people,
We wey dey struggle, wey dey hustle for the rouble.
Make we feel your love, your care and attention,
For we be your citizens, we deserve protection.
Baba Jagaban…
Make we see government dey for the people,
No be to dey yarn dey sign, na to take action and to tackle.
We need your leadership,
We need your empathy, Make we feel say Naija go better, na our destiny.
Baba Jagaban…
show masses say you carry we.
Increase minimum wage, provide jobs,
No remove health subsidy, no increase electricity tariff.
Make govt too benefit di masses.
Baba Jagaban..
Na time to act, no be just to talk, Make we feel say you dey work, you dey walk the walk.
For Naija to shine, we need your commitment, make we see progress, make we feel the fulfilment.
… Lisa Bassey, a writer and public commentator is based in Abuja.
An Open Letter To The President, Baba Jagaban
Leave a comment
Leave a comment


